Akwa Ibom state govnor lose im wife

Spread the love

Wife of Governor Umo Eno of Akwa Ibom State, Patience Umo Eno don die, di state goment confam.

Na Ini Ememobong, di Commissioner for Information for di state tok am on Friday.

“Na wit heavy heart we announce di passing of di Wife of di Executive Governor of Akwa Ibom State, Her Excellency, Pastor Mrs Patience Umo Eno,” Ememobong tok for di statement.

Di statement say di wife of di govnor bin dey sick – e no tok di kain sickness wey worry her.

E add say di govnor wife Patience Umo Eno die for hospital on Thursday “in di presence of her family”.

“Di family submit to di will of di Almighty and ask for di prayers and support of kind-hearted individuals during dis difficult time.”

Ememobong say di family go provide more informate wen e dey necessary.

Di last time Patience Umo Eno dey active for social media na on 24 September, 2024 wen she follow mark di 37th year anniversary of Akwa Ibom state.

Patience Umo Eno profile

Di late Patience Umo Eno na di wife of Akwa Ibom state govnor.

According to one of her Facebook post, dem marry 37 years ago.

According to local media The Nation, she from Ikot Akpa Ekop, wey be one of di communities for Ikpa Ibom.

Na one of di biggest clans for Mkpat Enin. Di community get plenti oil and dem dey farm too.

She get six children and nine grandchildren.

Wit di project she bin provide water for communities, campaign for support for breastfeeding mothers,

She also dey provide accommodation, food, and education to improve pipo lives and di livelihoods of poor and vulnerable pipo.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Previous post Nigerian soja wey chop sack on top accuse of rape react
Next post See di reason why Nigeria goment increase NYSC ‘alawee’ to 77,000 naira